Subscribe Now

* You will receive the latest news and updates on your favorite celebrities!

Trending News

Tori

2023, Na Year For Planning
Wetin My Eye Don See by Clement Neebeke

2023, Na Year For Planning 

As we don enter dis new year 2023, e good mek all of us plan how d new year go be for us and our family.

Some pipul no remember say e get wetin oyibo dey call ‘planning’. You fit call am budget, or new year resolution.

Even Bible sef talk am for d book of Luke, Chapter 14, verse 28, say: “If you want to build house or do any kind of project, you go make sure say you sidon, count d cost, becos if you no count d cost, d project fit hang for road wen money don finish”.

But some pipul no know say all project, weda small or big, need planning, especially as tins dey for dis country now.

Even as small as to give woman belle, some pipul no know say na big  project be dat, wey be say if e no happen as you tink, you go run helter-skelter.

Yes, because, no be God go plan for you. If you no succeed for your planning last year, dat no go stop you to plan dis year and den pray to God to bless d works wey you carry for hand.

As you dey read so, know say you suppose don make budget for school fees, foodstuff, hospital bills, antenatal, vacation and odas.

Na so my friend, Chief Uche, him wife go for ante natal for hospital. As she reach, doctor check her finish say her pelvic too small for pikin head to pass come out, so she go need to do operation.

But becos my friend, Uche, no remember say woman wey get belle need budget too, him no put am for him plan for d year. Na so d tin come choke am wey be say my friend dey call all him in-laws, friends, colleagues and relatives to get N250,000 for d operation, but no one gree say money dey him hand becos dem no budget for Uche. Maybe d budget wey dem make na for dia own wahala.

Na so Uche come dey call call everybody sotey him come dey sweat, nearly faint.  Doctor sef wey dey look am from corner eye come see sey small small anoda tin wan happen for him hospital.

Doctor come by force seize all my friend three  phones, take style style give am medicine so dat him go relax, from dere, Uche come sleep go far far.

God come see say, if sometin no happen, Uche fit go meet him ancestors like play like play.

Na so God come touch d doctor for mind, wey be say, before Uche wake up from him deep sleep, dem don finish d operation. Doctor come tell am mek him go with him wife and pikin and go find money come pay. How many doctors go do like dis for we country now?

D tin be say, no be so e dey happen for everybody. Na true say God dey. Yes, God dey for everybody, becos if you look as tins dey happen for dis world, especially for dis our Nigeria, nobody go tell you say God really dey gidigba for Nigerians.

Wen you cool down, come dey imagine everytin wey dey happen for Nigeria: how d price for everytin, especially food to eat, dey increase every second, and how becos of no way to way, pipul dey go into every and every criminal activity, wey be say ritualists don full everywhere, sotey e come be like say na normal tin, you go know say God really dey wit us wey don survive reach now.

But, God dey no mean say you no go do wetin you suppose do to survive. After all, Bible sef talk am say God go only bless d works of our hand. Dis mean say, na wetin we dey do wey God go bless. So, if we no come dey do anytin, from wia God go come bless us?

Na im make e good mek we always plan for everytin wey we dey do for dis world. Dis no be time to sidon, fold out hand come dey expect d kind of miracle wey God do for my friend, Uche.

But, even d Uche wife mata sef, wen him don see say water don pass garri, shebi him come dey run helter-skelter before God come pity am, come touch d doctor for mind. So, you see say, Uche sef do sometin before God come pity am come help am. But we no suppose wait till water pass garri.

Na im make we dey tall everybody to plan inside dis year 2023.

D tin wey my eye don see for dis Nigeria plenty, especially for pipul wey no know say to survive for dis world, every person need to plan for everytin becos many times, na wen we no plan well we dey blame our village pipul for problem wey we dey face.

Abeg, mek 2023 be d year wey we begin to plan everytin for our life

Related posts

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments