Subscribe Now

* You will receive the latest news and updates on your favorite celebrities!

Trending News

Tori

419 Gorment Don Do
Dem Say by Nuye Aaron

419 Gorment Don Do 

Countryman, you know say, for dis Naija, Gorment don do us plenty tins. Sometimes person go jus vex sotey d vex go turn to laf, becos of sey, d mata just tire person.

Just look inside dis fuel mata, for example. See wetin Naija pipul dey suffer everyday. True true d situation don become “suffering and smiling”, like Fela Anikulapo-Kuti been sing sometime ago.

If you tink back back, you go remember say inside 2015, wen dis present Federal Government come to power, fuel price been be #89.00, and d time wey d gorment dey talk to Naija pipul before d 2015 election, one tin wey dem take make Naija pipul bele sweet be say, dem go bring d price of d fuel down to #45.00.

Anoda tin be say dem say dem go remove fuel subsidy, wey be sey d Federal Gorment dey pay plenty part of d money wey dem dey take import fuel from outside Naija, so dat Naija pipul no go pay too much for fuel, becos Gorment dey pay for d bigger part.

Dis gorment even talk say inside dia first four years tenure for office dem go repair all d four Refineries wey Naija get, so dat wen we begin produce fuel as we been dey do before, Gorment no go import fuel for outside again, and d price go automatically come down for Naija.

Country pipul, we know sey we don pass dis level of 419, becos e no happen as dis gorment talk. Wetin wey come even vex pipul pass na be sey, d gorment no fit even accept wetin dem talk. Dem dey deny sey dem no talk dat kind tin.

E come be like sey dem dey talk to small small children, sey Naija pipul no get brain to tink, or sey na so d pipul mumu reach.

Since dat time till now, Naija pipul know wetin dis Federal Government don lie to dem: plenty tins wey dem say dem go do wey dem never do; beta beta life wey dem say dem go give Naija pipul wey dem no fit do; and d kind suffer head wey dem don put for Naija pipul head, wey come make pipul no fit to get food to eat, wey be say pipul don dey do plenty bad bad tins to survive.

Now, Naija pipul don vex sotey dem don dey laf every time d gorment begin to dey talk all dis dia 419 talk dem.

Notin wey dem never talk about how dem want to make life easy for country pipul. E don come be like say d more dem dey talk d 419 talk, d more suffer head dey pour on top Naija pipul.

Any time dem talk d 419 talk, and e don dey reach d time wey dem suppose fulfill wetin dem talk, and dem no fit make am happen, dem go give anoda 419 talk, just as dem been say dem go repair Port Harcourt Refinery finish for December 2022, and e go start to produce 60,000 barrels of fuel every day.

Now dem don say, na d first three months, wey be quarter for 2023 wey d Refinery go start to produce.

Now, dem don come again with anoda 419: dem say dem go stop d fuel subsidy for June dis year.

Country pipul, see d level wey dis gorment 419 don reach?

Abeg, na for wia dis gorment go stay come remove d fuel subsidy, after dem don commot for power inside May dis year? Abi na d gorment wey go come after dem go remove am?

Na for which time e happen say new gorment come for Naija wey no pursue dia own agenda, come dey do d agenda of d gorment wey don go?

Or dem dey take style dey talk anoda 419 talk, sey any gorment wey come dis year wen dem don comot must to correct dia 419 arrangement talk?

Countryman, tink-o! As we dey take position, dey arrange ourself to vote for d 2023 general election next month, Dem Say dey talk am sey 419 Gorment don do. E don reach when country pipul suppose use dia tongue count dia teeth, as oyibo talk am.

Suffer head don do-o!

Related posts

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments