Who We Be (Who We Are)
Tori4Town na d first pidgin English Grassroots TV Programme wey dey cover d gap between local communities dem, wey be our small towns and villages, and Gornment, since 1998. Na Countryman Iyowuna Obomanu wey bring d idea.
As him bring d idea for Rivers State, na so d idea come grow reach outside d State come enter Nigeria and pipul for everywhere wey watch d programme come dey happy, becos as e dey make dem laugh, na so e dey make dem know wetin Gorment dey do for dem, and Gorment too dey know wetin to do for d pipul as Tori4Town dey tell Gorment wetin be d pipul problem.
Since 1988, d Tori4Town TV programme don grow well well and become popular and everybody, big and small, dey enjoy d beta beta news wey d programme dey carry and make everybody dey laugh and happy well well.
As e come be, pipul come get popular demand, wey be sey dem want Tori4Town wey dem want to read. Na so d same idea come born Tori4Town Newspaper inside January 2023.
As e be sey TV na only watch dem go watch, now pipul don get newspaper wey dem go fit read and dey laugh as dem dey get better information from Gorment, and Gorment too go hear their voice from d grassroots, wey be awa rural communities. And becos of d digitisation, wey be sey anywhere pipul dey, as far as sey dem get internet, dem go fit get any information from d world, na so Tori4Town come enter d digital world too, with dis online version, so dat country pipul go get information as e dey hot.
Wetin We Carry For Mind (Vision)
Our plan na to use Tori4Town to promote and make awa pipul for d grassroots wey be our local communities, to understand wetin Gorment dey do to make life better for d pipul, and also make d pipul know say dem need to work together with Gorment to promote beta progress for everybody.
To make dis cooperation between Gorment and d pipul to work, Tori4Town dey report activities and programmes of gorment, plus problems and challenges of d pipul to make gorment know d problems of d grassroots pipul.
Tori4Town dey carry news from Gorment wey concern d pipul, and also news from d pipul wey Gorment suppose know as things dey with d pipul, and everything na for special English, wey be pidgin English, so dat everybody, big and small, go fit read am and understand am, and na Ultimedia Production dey package and organize am.
Tori4Town go continue to provide good opportunity for grassroots pipul to fit talk their problem and bring Gorment attention to d pipul, and promote beta corporation and understanding between d rural communities and Gorment for better progress and development