You wey be young boy and young girl allias young adult, according to Oyibo, na you I dey talk to. Yes, you I dey take Okpolor eye dey look so.
E no go good sey we just dey live our lives dey do tins anyhow anyhow without anybody dey tell us wetin we suppose hear, especially as e take concern us.
I go dey write to una from time to time through dis medium so e go good make you dey watch out for Tori 4 Town newspaper so dat you no go dey miss all d small small information wey I go dey give una from time to time.
True true, wetin young people dey face e big well well and plenty of dis our young people no get dat moral to fit confront d older pipul, ask some kind questions wey suppose serve as escape route.
Dis lack of moral, allias high self esteem, as Oyibo man call am, e don make plenty young people go put hand and body inside wetin no good, all in d name of living life.
Some no even know dia left from dia right, na im make any breeze wey blow dem dey follow am go anywhere e dey blow go. Later, wey dia eye don clear, dem go come shout ewoooeehh, village pipul.
For dis particular edition, Okpolor Eye dey look inside small matter wey go help young people at dis point of dia life, especially as e take concern dem for Nigeria, allias Nigerian youths.
Okpolor Eye dey shook eye small for inside how young pipul dey take make money today, both boys and girls.
We know sey times dey hard for our country, Naija, and life here hard scatter because d fan no dey rotate. So, na only one side d breeze dey blow and instead of everybody to tink of how we go take repair d fan so dat e go dey rotate mek breeze try touch everybody, rather all of us dey struggle who wan dey in front of d fan.
Na dis struggle na im dey make d country dey hard more and more.
Now you know sey young pipul for Nigeria make up a good number of d population, and inside dis young pipul, some don finish school as graduates and professionals for one field of life or d oda, while some no even go d school at all.
Some wey get privilege start d school don even drop out and some odas just dey like dat. D country come hard sotey d few ones wey even go d school come qualify no dey see work do and all dis tings dey direct young people mind to quick quick means of how to make money, because most of dis young pipul get big big bills to settle, but dem no get work wey go give dem d kind money wey dem go use live dia lives.
Yes na! Na im make we wan talk about d quick quick ways wey young pipul dey take gather all d money wey dem dey spend, wey dey wrong for God eye and man.
Shey you sef don dey hear several plenty plenty stories of how young pipul dey run kolomental? Some don die finish, while odas don use yama yama drugs take scatter d small skeleton wey remain for dia body finish.
Countryman, no be small matter-o!
Shey you sef you dey see as young pipul dey take live expensive and luxurious lives abi? Yes na!
Say young people dey live expensive lives no be my problem be dat-o. In fact, to live expensive and luxurious life no be sin at all. E good well well.
But wetin come make us dey concerned for d matter now na sey most of dis young pipul wey dey live all dis kind of life no get any single work or even handwork wey you fit trace dia wealth to.
Chei, countryman, d matter serious oh, e come be like woman wey nobody dey see wen she dey get belle, but before you know, you go hear sey she don born pikin.
Countryman, true true d story no clear at all. How e sound for your ear na? No, dis tin no good at all.
Na im make we dey call on all our young pipul sey as d new year don start, e go good mek you wash ya hand commot for evey bad katakata wey you dey take make money wey you know sey dey bad.
As a young person, d first spirit wey you go carry wear like agbada for dis new year, na wetin Oyibo man call “spirit of contentment”.
Dat one come mean sey, mek every small tin wey you get belle full you. Mek you no dey put eye for anoda person own because we don discover sey na too much big eye na im make most young people dey go extra mile to make money, and even use ways wey no good.
So, e go good mek you, as young person, ask God to give you d spirit of contentment, so dat any small tin wey you hustle for legitimately go belle full you.
As a young person, because d country don dey d way e dey, e go good mek you sef try learn small handwork, so dat you too fit dey solve pipul problems and dey make small small money wey you fit take dey sustain yaself because Oyibo man talk sey “There is dignity in labour”.
Different different plenty handwork dey wey you fit learn, as a young person, take dey help urself. Commot ya hand for jagarabuba life.
Commot ya hand for yeye yeye tins wey no go profit you good. Commot ya hand for yahoo yahoo life, commot ya hand for bad bad tins.
Stop to dey take hard drugs wey go quickly help you kill ya future.
Do better tins make money so dat you sef fit enjoy your money with peace of mind and excess joy, but no forget, for everytin wey you go do dis new year, always allow d fear of God to rule ya actions.
Related posts
Subscribe for newsletter
* You go receive the latest tori wen you put your email