The judge come ask Mr B weda as de pikin white like snow na d only tin wey make am say d landlord na him get pikin.
Mr B say wen him carry d pikin go out, pipul dey greet am well well. But after dem see d pikin, dem dey laugh am say d pikin no be him own. Mrs B come say na so people dey talk about d pikin wen she comot with am too.
She say she dey suspect say d hospital give her anoda person pikin na im make d pickin no resemble her and her husband.
Dis tin wey Mrs B talk come put d pipul wey dey reason d mata into more confusion. As Fela Anikulapo-Kuti sing for him song, ‘Confusion don break bone’. True true, confusion break bone.
Judge look Mrs B, come shift him eye go look Mr B. Him come shift d eye again, come put am on top Landlord. As him eye dey shift so, e be like sey plenty tins wey him dey tink about dey go round and round for him brain.
Small time d eye come shift back again to Mrs B. D eye come open wide, den come close to normal again before she come start to talk.
Judge come ask Mrs B wetin she mean: weda she dey claim sey d hospital give her wrong pikin, or na sey Mr B get na im get d pikin.
D mata come dey be like sey more confusion wan break bone: as Mrs B come confuse, na so everybody come confuse too. But na wen Mr B come jump inside d confusion wey pipul come see say na only him no confuse for d mata.
Him say weda na hospital or Landlord, wetin him know be sey d pikin no be him own. So, na who come get d pikin?
Judge come say when bird learn to fly without perching on top tree, d hunter must also learn to shoot without missing. She say d only tin to do for d mata na for Mr and Mrs B to do lab test wey oyibo dey call DNA to know two tins: weda d pikin na Mrs B own or not, and weda d pikin na Mr B own.
Na so d court take adjourn till d following week for judgement.
Wen d court come sit again for judgement day, plenty pipul don take interest for d mata. D court come full to capacity, everybody wey get interest dey for court, no sit wey dey empty inside d court.
Mr and Mrs B dey, Chairman, Nackers Association of Nigeria (NAN) dey, Association of Sperm Donors (ASD) and their rival women group, Association of Sperm Receivers (ASR) dem Chairlady dey too. Me sef wey be Barrister Nackson, Senior Advocate of Nackers (SAN), too dey in my full regalia.
As d Judge take position for her sit, she raise d hammer, nack am, come shout ‘order !!!!. She come start to talk.
She say before she go read d DNA result and her judgement, she wan ask Mr B weda him still believe say d pikin no be him own. Mr B shout Yes!
She come ask Mrs B weda she still say d pikin na Mr B own. But wen Mrs B answer, plenty pipul for d court no hear, because na very small voice come out for her mouth.
Tension come dey increase for court. Everybody wey know wetin dey for inside d mata dey feel d tension inside d court. Pipul eyes dey move from Mrs B to Mr B, to d pikin, and den to Landlord.
Judge come start: she first read out d DNA test result. She say d result show say d white pikin na Mrs B pickin.
My pipul, before we know, dis serious mata come take anoda serious dimension: argument come start for court, some say na landlord get pikin. Odas say na lie.
For Chairman of Nackers Association, him change d mata to gamble, sey him go bet say na Landlord get d pikin. Chairlady of Sperm Receivers say na Mr B get d pickin. Dem bring out money to bet, but unfortunately for dem, no NackBet betting platform dey inside coirt.
Judge come call order for court again. She come say d DNA result also show sey d white pikin na Mr B own. Court scatter again for anoda round of gossip talk, everybody dey talk for somebody ear.
As pipul for inside d court dey try to understand wetin d Judge talk, plenty of dem no come hear d real Judgement. Wetin dem hear na wen Judge dey advise pipul.
She say mek pipul no use colour of pikin, or pickin face judge weda pikin na dia own or not, say anytime wey dia mind do dem somehow, mek dem go to family court for DNA test.
Na so Mr and Mrs B minds come come down from up, and dem come happy sey d white pikin na dia own.
As pipul dey happy dey go, as SAN, I just dey carefully watch Mr B and d Landlord. I see Mr B eye Landlord, Landlord retaliate wit anoda dangerous eye.
Countryman, as e be so, dis mata fit get anoda dimension-o! Experience dey tell me sey weda d pikin na him own fit no mean say Mr B go forget say Landlord don nack Mrs B.
How e go be for Mr and Mrs B for inside dia house? And where Mrs B and Landlord go keep dia face for inside d compound wey all of dem dey live?
Related posts
Subscribe for newsletter
* You go receive the latest tori wen you put your email