Dis week, Okpolor Eye carry waka enter for nkoroway for inside Port Harcourt. D waka woski, and wetin Okpolor Eye see, and wan talk, na wetin plenty pipul dey see, but dem don feel say e normal becos e dey for everywhere.
D mata wey Okpolor Eye carry come today na d one wey concern young pipul and d way dem don take employ demselves for Gas Turbine Industry.
Dis Gas Turbine Industry no be d oyibo gas turbine I dey talk about, countryman. D one I dey talk about na d main one wey Stereo Man, dat musician, sing sey “if e good for your health, smoke, if e no good for your health, quit”.
Countryman, you don notice sey, dese days if you waka for ya street, town, and even small small villages, young pipul, and even children for some places, don dey smoke almost everytin dem see?
Yes, young pipul don take dia hand give demselves employment letter for dis Gas Turbine Industry as e be sey Gorment no fit give dem work, as dem talk.
Young pipul don dey sell and smoke almost everytin, including odour wey dey come out from latrine, all becos of highness, so dat dem go be His Royal Highness, or Her Royal Highness.
Both boys and girls don dey fire from all corner inside wetin Oyibo call “craze for highness”, wey be say everytime dem wan mek dia eye dey well, dey do one kind one kind, especially wen dem dem sidon together, dem go jus dey fire ahead ahead.
Some don smoke everytin dem see sotey d color of dia skin, especially dia face, don dey change colour like chameleon.
Countryman, if you know d amount of wetin young pipul dey smoke dese days, hmmmm! Plenty young pipul, both boys and girls, don make gas turbine dia own industry, and e no good at all.
Na im make Okpolor Eye come dey ask dis question, “how we take reach here as a pipul? How our young pipul take come reach dis age of Gas Turbine Industry?
Okpolor Eye remember dat period, for before before, wey na only few young pipul na im you go see for dis GTI. But, today, d number of workers, allias smokers, for d industry don plenty, no be small.
You go hear young pipul dey give different different reason wey make dem join d industry: some talk sey dem dey enjoy d work because dem dey use am oppress depression, wey be sey, anytime dia mind spoil, d industry dey make dem forget dia trouble.
Some say dia own na becos of sey dia friends ginger dem, give dem moral so dem just wan feel among.
Odas say dem dey join becos dem wan kill fear, pain and tension, and plenty wey dey for dis category na d ones wey dey take am go worry oda pipul for society after dem don get moral wen dem don take something. D result dey for everywhere for everybody to see.
Countryman, you know sey dis gas turbine industry work na very bad sometin wey young pipul for dis generation dey fall for plenty times.
Plenty young pipul don dey enjoy dis gas turbine work wey be smoking and na so dem dey graduate into adulthood with dis same habbit.
Oyibo bin don talk am sey statistics don show sey 45% of senior gas turbine staff, allias smokers, today, bin start as children or as young pipul, and say out of dis number, about 15% dey die from small small yama yama sicknesses wey dey follow dis gas turbine practice.
Remember sey gas turbine wey be cigarette na tobacco wey contain hundreds of chemical wey get power to destroy person wellness, allias health.
True true na plenty chemicals dey inside every stick of gas turbine and about 400 of d chemicals na wetin Oyibo man don confirm sey fit cause dat yeye sickness wey dokitor dey call cancer.
The tobacco wey dey inside gas turbine contain Nicotine, Cyanide, Carbon-monoxide, benzene, formaldyde (wey dem dey take preserve dead body) and ammonia (wey dem dey take manufacture fertilizer wey farmers dey take support plants to grow well well and quick quick.
D funny tin be sey, nobody wey dey go into dis gas turbine industry wey no know say e no good, but notin wey you go tell dem wey fit make dem stop am until dem reach dia Promised Land, like d Canaanites for Bible.
But for d gas turbine wey we dey talk for here so, one person Promised Land fit different from anoda person own: one person Promise Land fit be cancer, d oda person own fit be Tuberculosis, allias TB, wey be dat very bad cough wey wen person wey get am dey cough, e dey pain am from inside chest dey come out, and sometimes blood stain dey come out wen e don bad well well.
Some pipul wey dey inside d Gas Turbine industry wey dey do am like sey na school, dem dey graduate from one level to d oda: from common cigarette to “Igbo”, wey oyibo dey call marijuana.
Dem go later upgrade to “white”, “Brown”, “Coke”, Gbana” and plenty oda tins wey dem dey smoke dese days. Na so every day different different new tins wey dem dey smoke dey come out.
And dis tin don cause plenty wahala for pipul, young and old, becos sey d old ones today don dey inside since dem young, and dem no fit leave am again.
Look well countryman, most of dese Gas Turbine Industry workers wey God keep until dem grow old, dem dey regret dia life, becos sey d tin dey change dia life inside out, wey be sey dem dey suffer from one sickness or d oda, wey dey kill dem at d end.
Na im make Okpolor Eye dey dey advise pipul: you be mama, papa, uncle , brother, sister, nwabobo and nwababy, abeg mek you try dey encourage your people anywhere dem dey mek dem stop d Gas Turbine if dem love dia life.
Mek dem use dia time do beta tin for demselves and society, becos, one way or d oda, dem go regret am.
Related posts
Subscribe for newsletter
* You go receive the latest tori wen you put your email