Subscribe Now

* You will receive the latest news and updates on your favorite celebrities!

Trending News

Tori

No Be Everytin  Eye See, Mouth Dey Talk
Wetin My Eye Don See by Clement Neebeke

No Be Everytin Eye See, Mouth Dey Talk 

Bible sef talk am in d book of Job, Chapter 15, verse 3(a) say, “should he reason with unprofitable talk”?

Wetin me I understand here b say, weda him (wise man) go justify, explain or identify with talk wey no go benefit am? Or mata wey no concern am?

E get wetin happen to me one year wey make me come reason dis advice for Bible, and e come remind me too of wetin my grandfather dey always tell us before him die, say “no bi everytin you see wey you go talk, becos if you talk all de tins wey your eye see, you fit talk finish enter big wahala.

Dis advice na true my pipul. Na so I enter motorcycle from Slaughter for zoo area, inside Port Harcourt, dey go Garrison one day, I come see anoda motorcycle man wey carry two big girls along Modacat area for Trans-Amadi.

My pipul, wetin I see wey two of dem wear bi like trouser or skirt, but d problem b say e no cover dere bombom at all.

Anoda bad tin b say two of dem wear jigida (beads) and all dis tins dey for outside. Na here my wahala start.

As man wey come from beta Christian family wey dey God fearing, I no like wetin I see. So I come tell my motorcycle man make him increase speed so dat we go meet d girls make I advice dem to carry dere trousers or skirts up to cover wetin dey give woman respect, becos all dere bombom dey show for everybody to look.

As we drive near dem around Nkpogu Bridge, na him my bykeman slow down, I come tell dem say all dere buttocks dey for outside and e no good to see for eye.

Chei, my pipul, dis two girls nearly jump down from dia byke come fight me oh!

Na im I tell my bykeman to run pass dem becos I no want make d good wey I do put me for trouble. As we reach Garrison, dem come drop for dere thinking say me I go drop dere too, but I get sense, so I come tell my bykeman to carry me straight to fire service park for Abali flyover.

Before I know two of dem don jump enter d same byke wey carry dem, come dey pursue us go reach de flyover area. As we just reach wey I dey fast fast wan pay my bykeman so dat I go run comot, see two of dem don come with speed, jump down hook me for my etibo wey I wear dey go occasion for Abonnema.

D tin wey I hear from dia mouth be, “oga you must pay us our money now wey we don catch you. Na so ona dey waka dey sleep with girls finish, give dem fake cheque wen money no dey for ona account. Today na God deliver you put for our hand and we no go leave you until you pay all our money”.

My pipul, I jus confuse. My okada man and d two okada men wey bring dem come even confuse pass me. Dem come dey ask me weda I know d girls before?

Na so I explain tire, nobody wan hear my side of d mata. Everybody don dey say oga pay dem na make dem no disgrace you for public.

D bad tin be say, as I still dey for d shock of wetin d girls dey talk, e be me like say na play. Even as I dey try to explain, my mouth just no dey go straight because of d surprise of how dis girls just change d whole mata.

Before I know, agbero boys wey dey around don start to dey push me small small. D third agbero come from my back. As I see d movement, just dey turn to face am na so I see d dirty slap wey him arrange to give me from back.

As I raise my left hand block am, na im all of dem pounce on me. Some dey slap my head, some dey blow my body as e be say I dey block my face.

As dem dey beat me, na so dem dey shout dey ask me why I dey disgrace men, dey sleep with woman and no gree pay dem mek dem get money take look after demsef.

As dia hand dey pound me, na so I come see my Deacon for church wey dey pass nearby. I come shout him name.

Na my Deacon for church wey dey pass nearby come see me. Him come beg dem to stop t beat me, come ask me wetin happen?

As I dey try to get myself dey explain to am small small, d agbero boys dey shout to cover wetin I dey talk so dat I no go fit make sense. But I come cool down tell d Deacon as e happen.

To cut long mata short, d girls claim say I sleep with two of dem and suppose give each of dem N2,500, say na N5,000 I dey owe dem.

Na my Deacon come pay N5,000 wey him no bargain for, just like dat. As we comot from d place, him come advice me sey no bi everytin wey person eye see, wey d person mouth suppose talk.

My pipul, na so my Abonnema trip take end for Abali Park dat day. D only happiness wey I get be say, d Deacon promise me say nobody go hear am for church.

Related posts

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments