Countryman, Okpolor Eye no be open eye oh!
As we dey carry Okpolor Eye dey torch light d city, na so we come see sey true true d way wey young pipul dey take rush life don become unbecoming.
Chai, Countryman, if you see d way wey young pipul dey take pursue d tins of dis life ehn, you sef go raise your head look heaven because d mata woski.
Many young pipul don dey in a hurry to achieve d tins of life, but no be mata at all oh. Of course no be bad tin to pursue d pleasere of life at a young age. No be crime at all.
But sey e good to know sey life wey we dey live na step-by-step and na prcocess after process.
Countryman, see, many young pipul don dey do gragra, dem no really wan keep dia head for ground learn. Dem no wan take dia time learn. Everybody wan blow d same day and everybody wan collect d same day.
Some young boys and gals no know sey d life get process and you must to pay d price for life to achieve d good tins of life.
As a young person wey you be, d best tin wey you suppose do for yourself for dis level of your life na to calm down, take your time learn well.
Na failure to learn na im dey make most young pipul crash early for life. Some wey even wan learn no dey get patience to humble demselves learn well.
As dem try know small, vooom, dem don conclude for dia mind sey dem don sabi, and dem don dey ripe to chop life belle full.
Na im make now we get plenty boys and gals wey dey do one tin or d oda wey we use our eye see as pipul wey never baff well.
Even for our families, our schools, our small small towns and villages, we get dat young person wey we know sey no dey wan gree learn, but wan dey comfortable overnight.
Abeg, If you get dat kind person around you, just help Okpolor Eye tell dat person sey dat spirit wey no dey allow pipul calm down learn, na evil spirit.
Tell dem sey dat spirit no good at all. Tell dem mek dem calm down learn, and even if na you be d young person, I want mek you try take your time learn dat tin wey dey your mind becos, according to Oyibo man, “Rome was not built in a day”.
E mean sey, Rome, wey be capital of Italy, no be one dey dem build am. Dem take time build am small small sotey e come fine.
Abeg I use God name beg you, yes, you wey be young man or woman, commot your eye for sharp sharp success. No use short cut. Calm down, pay your dues today, so dat you go enjoy your tomorrow. Too much rush rush go carry you back to d starting point.
Most young pipul no really know sey d reason why plenty old men and women full road today dey hustle anyhow na because of sey most of dem useless deir youthful age, dem bin dey play with dia life dat time, and dem tink say na enjoyment dat time.
Plenty of dem bin no take learning serious, dem just play around life and today dem dey hustle day and night wey be sey by dis time of dia lives dem suppose just relax dey eat d fruits of dua labour.
Shey you want mek your own be like dat, abi you go want mek you retire to a life of jolly jolly wen you don old?
Even if na waterslide you grow up, abi na inside GRA wey you grow up, abeg no allow your background carry your back nack for ground because you owe your children answer to one question wey you no fit deny, and d question na, “where you dey when your mates dey hustle?”
D time to fold hand don pass. Stand up, calm down, humble yourself, learn, learn and learn well, den wen time reach, practice dat tin wey you learn in d right way, den put am for God hand. Mek you see if God no go bless d labours of your hand.
No forget sey money no dey fall from heaven. Learn beta tin, den use your hand do beta tin, so dat money go follow you.
As e be sey na new year be dis, abeg Okpolor Eye wey dey your neighborhood dey use God name beg you sey anytin wey you dey do dis year, mek you know sey life na gradually gradually process.
Take life small small, learn wen you suppose learn, get patience learn well, meet new people, make good friends, ask questions, get beta character, learn to dey talk truth all d time.
No dey allow d pressure of life push you to go do wetin no good, all in d name of survival. Take life small small. Learn to live according to d size of your pocket so dat you no go tif.
Mek you remember sey, if you no take your time learn today wey you dey young, you go live all your old age dey hustle wen you suppose enjoy.
Related posts
Subscribe for newsletter
* You go receive the latest tori wen you put your email