Countryman, dis mata wey dey for ground heavy well well, and we go talk am as e be. We go also look am front and back, left, right and corner, becos why, tins don spoil well well for dis country to d point wey we dey only see dem from one side.
We no dey look am from anoda side. My broda, coins get two face oh, and each face different from d oda, with dia different logo and symbols.
Some coins get human head for one side, while some get horse for d oda side. Na so e dey for every coins, and na so all dia meaning different.
Countryman, me and you, all of us know say Kpo-fire, allias illegally refined petroleum product, no good at all. Every tin about kpo-fire from d beginning of production to d final product dey very dangerous, disastrous and bad to our health, our environment, our economy and ecosystem.
Starting from d point wey dem go break d oil pipeline to get crude oil to wia dem dey boil d crude oil to get d finished products, even d point of selling or during supply, all of dis process dey very very dangerous and harmful to all of us and our economy.
But, countryman, make we ask our self one simple question: which time wey you see beta Kerosene last for dis country, or, you carry your jerrican go buy beta kerosene for filling station?
Dat is to say, original kerosene wey dem produce for our refinery, or kerosene wey our Gorment import from oyibo country come for us to use for our stove and lamp.
Countryman, you know say, so many family for our country, Nigeria, no fit buy gas again to take cook dia food? Na kerosene stove plenty pipul dey use now, and since beta kerosene no dey for our country, na which kerosene all of dem dey use?
My broda, no deceive yaself oh, na kpo-fire kerosene everybody dey use. Even plenty road side Mama Put or restaurants sef, na dis same kpo-fire kerosene dem dey use.
Anoda tin be sey, because dis kerosene no dey enough for our country, e come make d price of kerosene high too much.
Kpo-fire kerosene price don go up sotey d price don come high pass even fuel price, and d tin just dey wonderment everybody, and even Gorment sef, countryman.
One tin wey come dey enter person mind be sey, na wetin Gorment really want d common Naija pipul to do under dis kpo-fire arrangement wey dem push us go enter? Or, abi dem no know sey na dem push Nigerians inside Kpo-fire?
Countryman, no be sey na joke-o. You too, just look inside d whole mata now: Gorment say mek correct country pipul wey dey manage to survive no produce and use kpo-fire products again, but dem no dey do anytin about providing beta fuel wey country pipul go fit buy.
As for kerosene, Gorment no even dey send am again, becos e no come be like sey dem dey import am again, and you no go even see am. So, na wetin Gorment want mek d poor man wey no fit use gas do, if no be to use kpo-fire kerosene, especially now wey as we hear, na kpo-fire fuel and diesel even dey for plenty filling stations?
No be say person dey talk say kpo-fire dey good, but, countryman, take ya korokoro eye and church mond look inside d mata well.
Na which option Gorment don give country pipul before dem dey stop d kpo-fire wey pipul dey take manage dia suffer head life for we country, even as e be say kpo-fire kerosene sef don cost pass fuel becos e don remain small mek one and half litre reach #1,500.
Common kpo-fire kerosene-o!
Related posts
Subscribe for newsletter
* You go receive the latest tori wen you put your email