D oda day, Dem Say been dey for one popular news stand for Port Harcourt, wey Free Readers’ Association dey patronize well well. Small time, one young bobo wey dey read from one newspaper to d oda just shout: “dis pipul dem dey misbehave-o! Dem tink say dem big pass dia party?”
Anoda member of d association wey be elder come ask d bobo d pipul him dey talk about. Immediately d bobo mention say na d G-5 governors, na so Tori begin from right, left, and center.
D pipul wey support d bobo say G-5 governors na d ones wey dey worry Naija, sey dem be d type of politicians wey dey feel say if tins no go as dem want, Katakata go happen, say na im make dem take Rivers State Governor, Nyesom Wike, as dia leader because na him be d baba of “I no go gree politics”.
Oda members of d Association wey support d elder say na true say d G-5 governors na gree die politicians wey always want wetin dem talk or want to happen. But d elder come ask one very important question:
Him say, “na which politician for Naija wey no be gree die politician today, wey be sey him go accept defeat, apart from former President Goodluck Jonathan?”
Everybody come quiet small, d opposition come dey look demself one by one. D elder supporters too come cool down listen to d question wey elder ask again.
Dem Say too come look into dis question wey elder ask, come realise say any how you look at d G-5 matter, e really get as e be, because if you look am from left, e get K-leg, and if you look am from right, e get bow-leg.
So, wetin be d matter wey G-5 dey fight for, and why dem come dey behave like sey dem big pass dia party, Peoples Democratic Party, alias PDP?
D matter be sey, G-5 say d PDP constitution say Presidential candidate and National Chairman of d party no fit come from north or south of d country, say if one come from north, d oda must come from south, and na so e don be since dis 4th Republic wey start since 1999.
G-5 say since Atiku Abubakar, d PDP Presidential candidate, na from North, say Iyorchia Ayu, wey be d PDP National Chairman and wey come from North too get to resign, so dat d position go go to South.
D question come be say, why PDP no wan keep dis dia law again? Why e be say na dis point wey d powers for d party come say na so e go be, and why e be say dem feel say dis neglect of d PDP constitution suppose start with d North?
Countryman, you know say na d same tin dey happen for d ruling All Progressives Alliance (APC), wey be say against d Constitution of d Federal Republic of Nigeria, d APC say dem dey present Muslim/Muslim (Tinubu/Shetima) ticket as President and Vice President of Nigeria?
Country pipul, if you take ya korokoro eye, and clear mind reason dis G-5 matter, come cross look d APC Muslim/Muslim matter, you go know say plenty tins dey inside dis matter wey d North never explain to Nigerians.
Na true say G-5 no big pass PDP, but wetin d pipul wey say dem no go follow PDP law be? Law wey don maintain peace for d party since 1999-o.
D same question go for APC too: na which pipul for APC wey dey say wetin dem want beta pass wetin Nigerians say good for dem since independence in 1960?
Why e be say na d same North dey wan pass backyard change wetin dey keep Nigeria one? D north go gree take am, if na south dey start am?
Countryman, dis G-5 matter, na d matter-o!
Related posts
Subscribe for newsletter
* You go receive the latest tori wen you put your email