Countryman true true Okpolor eye no be open eye, na d eye wey dey see everytin wey concern young people for our society, and dey say d matter as e be, and as e suppose be.
D mata Oplpolor Eye wan discuss today na how young people dey take wear cloth, allias dress.
Countryman, if you carry your mind go back go look d pictures of our grandmama and our grandpapa dem, den come carry am compare wit d way our young boys and young girls dem dey dress today, you go see sey d mata don get belle.
Chai, the way wen our young pipul dese days dey take dress fit make you open mouth ask yourself questions wey no good.
But d big question wey we no fit run from, na how we take reach here? How we take waka commot from d better way wey our grand mama and grand papa dem been dey dress?
During d time of our granny dem, wen dem been be young Africans, dem dey wear dia various clothes take cover dia nakedness and dia clothes been fine for everybody eyes because dat time na decency be d order of d day.
But, countryman, today d mata don change as we dey see young boys and girls dey dress anyhow anyhow all in d name of wetin Oyibo call modernization and civilization, wet be develoent.
Just waka for your street now, yes you!
Just come out from your house enter street waka small and you go understand wetin I dey talk.
You no go beleive wetin your eye go see. You go see plenty young pipul dey dress anyhow, both boys and girls. Dem go dey wear all kinds of clothes wey no good for normal people to wear.
Sometimes d kind of cloth wey dem dey wear no fit make you know when you meet correct mad person for road.
Some sey na crazy jean, wey tear tear for everywhere and parts of dia body wey suppose cover, especially for women.
Some of d women dey wear bumshot wey be say e remain small mek person see dia pissing instrument.
Some na mini skirt, some na marlians, odas na low waist, or skin tight.
D one wey dey pain pass na sey some young people now, especially d girls, don dey wear for outside cloth wey dem suppose wear inside room. Dem don dey wear am come outside and e dey normal for d society eye.
Sometimes wen you see dese kind tins you go come dey ask yourself weda dis people no get mama or papa, abi dem no come from home where elderly people dey.
Countryman, d matter heavy, no be small, because even inside church, you go dey see sey dis pipul dey make dis kind of dressing normal, and our men of God no dey murmur, so long as sey na dem or dia mama and papa dey bring d highest offerings and tithe.
Indecent dressing mata no be here, e don bad well well. But we go still dey shout, we go still dey complain untill our young pipul change from dia ways.
We dey hear some people relate relate d behavior of young pipil dese days to wetin dem dey see for films as e take concern dressing, but e no go good sey as young person, sey na everytin wey you see for film you go dey practice, because oyibo call everytin for film “make-belief”.
Dat one mean say, dem dey act d film mek pipul wey dey watch am believe say na so e happen, wey be say e no really happen dey wey dem act am, na just for the viewers to get high interest for the file..
If you be girl, mek you learn to dey dress well, cover your body well, your nakedness na im be your pride. If you carry your pride show d world finish, no better man go take you serious.
If you follow celebrity lifestyle carry your body show d world finish, you go only get fame but nobody go value you because dat tin wey make you dey sacred don become punlic. Dem don see am finish.
But d advice no be for only d nwababy dem oh, even d nwabobo dem too also dey affected.
Abeg mek you dey cover your nakedness well well, because your body na d temple of God. Mek you no allow your friends influence d way you dey dress negatively. Mek you dey teach your friends how to dress decently.
D truth about dressing be sey, e no cost to dress decently and e no go commot one single tin for your body to dress decent. And, wen you dress decent, e go attract respect and pride for you and make pipul accept and respect you for everywhere you go.
As we don enter dis new year so, Okpolor Eye wey dey everywhere dey beg you sey mek you try improve on d way you dey dress, make sure sey you dress to represent God, make sure sey you dress to make pipul around you feel comfortable.
No take your dressing fall anoda man, no take your dressing cause trouble for road, no take your dressing cause trouble for occasion, no take your dressing cause trouble for public gatherings.
Most importantly, no take your dressing cause trouble for yourself, because na d way you dress pipul go address you.
Enjoy your week. We go see again next week.
Related posts
Subscribe for newsletter
* You go receive the latest tori wen you put your email