Subscribe Now

* You will receive the latest news and updates on your favorite celebrities!

Trending News

Tori

Relationship n age
Debby & Her Facebook Friends

Relationship n age 

HMMM, age dem say na number. Yes, I agree, but no be for boyfriend and girlfriend mata o, for my side.

Truth, I no go like date person wey I senior. But I no dey against am. Pipul dey do am and e dey go well for dem. I remember once like dat, for my friend wedding. As we dey match enter church, na so my friend whisper to me, “I senior my husband with 5yrs o”.

Na so I shout, “What?”

To cut d long story, dem still dey married and come get beautiful children.

Oya, make ona read down watin my Facebook friends dem talk wen I ask dem d big question: “woman wey dey date man wey dem senior, how you see am?

“E good or bad, or e no mata? You go fit marry  man wey you senior?”

Age no min anytin for relationship. Na wetin person want na im him go go for.

My own be say since man fit marry small pikin and society no vex, if young man marry old woman or person wey pass am for age, me I no see any crime inside.

So long as d two agree and like demselves, chickina.

Una know say every relationship get him benefit,

Young women dey follow older men because say dem go take care of dem and give dem plenty money and attention.

So if young men follow older women for d same reason, notin spoil, na wetin d person want .

– Sokari Emmanuel

*

Age no mata for me inside relationship. Wetin really mata na true love.

As l dey now, l go fit date woman wen senior me with ten to twenty years. Na dem get true love, and l go fit marry her if she get wetin l need from my woman. Age na number.

– Hitman Abaye ozabor

*

For me oh, Notin wrong if person find love for younger person heart oh. Age dem say na number. E no mata so far love and understanding dey.

– Barr. Winnie Omuboba Morganson

*

Now, wetin dey for any relationship na understanding. To me, age no mean anytin. Person fit dey go out with who him senior but peace of mind no go dey. So, a lot come depend on d individuals, not age. Wen I still dey live for Lagos, my friend dey waka around Maryland. Na him one lady for bus stop see am, like am, begin talk to am. Him sef look d lady come dey like wetin she dey talk.

As dem finish, d lady ask am where him dey work make him give am phone number. Dis story wey I dey tell so, dis mobile phone wey dey everywhere now no dey. Na in d late 90s wey e happen.

As d man give am office number, she go call am and dem go dey talk. Na so dem friendship take grow and d man no even know say d lady senior am until she talk am.

Dat one no bother d man at all becos dem don understand each oda. Na so dem do sotey dem don become husband and wife. Till tomorrow, two of dem still dey jolly life. Dis one  show say na understanding na im mata

– Chiedozi Nwokoye

*

In my opinion, age no really mata wen we dey talk about relationship.  D only problem wey dey inside na if one party dey mentally immature. Den problems fit arise.

No get me wrong, even mature pipul too dey get childish behaviour, but wen young person own come join with dia lack of experience and maturity, d relationship go get k-leg.

From experience, dating or to marry a younger person wey dey mentally mature na good tin. Two of una no go ever notice age difference.

If na guy wey dey work, him no go depend on you. Him go take him responsibility as a man. Him love and respect for you go dey strong.

Also, as long as you dey proud of am, him go carry you like egg. Una no go ever get problem like, “I no blame you, na me carry myself give small pikin”.

D advice I go give anybody wey dey date a younger person be sey, once you notice childish attitude and tantrums, run!

If dem dey demand too much from you financially and can only offer sex in return, run!

If dem no dey proud of you, run!

But once  mutual connection dey, you go  enjoy d benefits,  forgetting say u old pass am.

Your partner go fight for you if any family or friend try to cross d line. Once love bind una, all d doubts go just fade away.

– Chantelle Tindall

*

Dis topic na ogbonge topic. Like I dey always talk say, every aboki with him kettle. Some men and some women dey like to follow person wey senior dem. Dis age tin na number to some pipul.

Like me-o, e go hard me to do.

But d tin be sey, ona know say some pipul na old pipul wey dey trapped for small pikin body, ehen,  if na dat type of boy, e go mature for attitude and mind, and age no go be problem,  e go just b number.

But mek we know say as time goes on, reality go show. E go get sometins wey d woman go dey act her age, if d man no hold body well, e go cause katakata. Truth be say, generational gap dey. E get wetin d man generation dey do wey maybe d woman own generation don do pass. E get a point wey both of dem go dey act according to dia moment.  So, if dem no dey mature enough to know how to manage dis period, e fit scatter dem.

Dis kind time d man go dey feel say d woman dey archaic, while d woman go dey feel say d boy dey childish.  But if we wey dey outside look am well, chuke eye inside well well, we go see sey d two of dem no dey archaic or dey childish. D two of dem dey behave according to dia era/time.

Sometimes na all dis tins dey make some women no dey too like young boys. Some women go say, abeg I no dey for young boys dem wahala. Instead mosquito go bite person, mek hand slap for leg. But las las, like I talk before, every aboki with him kettle.

I don see man wey say na woman wey old pass am na im him wan follow becos dem mature, dem get sense and know how to handle relationship and home. Him say d young generation pipul na urgent 2k. Dem wan go club, dem wan go party. E say d older women no dey too give trouble, Dem don see 99, wetin you wan take hundred do?

– Tessy Brown

*

To me, e no dey bad, so far as d woman go get respect and always see say d man na im be d head. Once d man see sey she concider say him be d man, trouble no dey. Dat point sef, d woman no go wan do trouble wey go make d man realize sey d woman him dey wit, or put for house  senior am. She sef no go want d man to tell her one day say she senior am with curse, so she go  dey behave well.

– Tamunodiepiriye Abam

Related posts

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments