Subscribe Now

* You will receive the latest news and updates on your favorite celebrities!

Trending News

Tori

School Wey No Get Admission Or Registration
Mainroad Life by Benjamin Paul Nsirem

School Wey No Get Admission Or Registration 

Countryman, e get one kain school wey people dey go now. D school no get admission, e no get registration, and d students no dey pay school fees. Dem no even dey get acceptance letter.

For dis school, d only tin wen you need to do na to go with your biro, book, phone, laptop or computer and start lecture or class. No research teacher, no Principal. Headmaster nkor? Dat one na big absent too.

Yes-o, na school. Complete school wey people wey head correct, very normal, dey go, but dia body and dia brain dey work differently. Dat is, d two dey waka separately go different direction.

D only tin dem dey tink for d school na “pam 3 from 4. If Liverpool is playing away and Manchester is playing home, it means that Manchester is a sure banker”.

But now, d school don big, but na d same problem, because now wetin you dey hear na “one game cut me, I dey go cash out, shey homeman wey I carry over, 1 go play eyeglass”,  and all those kind of talk dem.

But, countryman, d tin wey dey pain me for dis mata na be say some of dis pipul wey dey go dis school dey use different different levels do dis tin: some dey borrow money put, some dey play wayo get money put, some dey even tif to get money to put for dis big school.

If you look inside d mata well well, you go blame no go blame d pipul wey dey go dis school finish-o.

D school sef no get better name. In fact, if you come tink am well,d real name of d school na “suffer suffer school of high blood pressure”.  You know why? Na because d only tin wey dey make d school progress na the different different suffer suffer wey dey insisde this country.

Countryman this one na wetin unemployment, greed and bad leadership don cause for our country Nigeria: lack of youth engagements, and even youth participation for governance and plenty oda bad bad tins wey make dis our country dey one place so tey pipul wey dey for our small small towns and villages dey follow see d suffer for eye korokoro.

All dus gbege dem na im join give muscle to dis school.

My brother wetin we dey talk here be sey, d level of people wey dey partake for dis football betting dey increase day by day so tey small children, I mean underage children wey never reach 18 years, dey follow go mark slip.

You, papa, mama, aunty, broda, uncle, make I give you one small assignment. Yes assignment. Just carry ur leg Waka enter some major streets for our cities and you go see wia pipul carry biro and book, gather dey look board as if dem dey search for their JAMB result.

Some pipul dey stand in front of computer system as if dem dey for ICT Center or cybercafè for  research project. My brother go closer, yes I sey go closer go see wetin dis pipul dey do and you go shock wetin ya eyes go see.

You know sey elders talk say if you no go under palm tree, you no go know if palm fruits don ripe or not.

Chei, countryman, wen you go closer na dat time you go discover sey na gambling, allias betting, na im dis pipul dey do for dis school.

Some dey check for dia scores wey dey for dia slip, odas dey find new games to play. Countryman, no be small tin-o!.

The worst part be sey, even craze man for road dey sell correct odd give pipul wey dey claim sey dem normal. Yes na! Craze man know sey you wey be normal person be him colleague for the business.

Na so one man go carry him wife Christmas contribution money go play dis bet, dey hope sey him go win. Countryman, as I dey talk to you now, d game cut. Yes, I sey e cut. D man slippers tear.

No be small tin-o, because, like dis, d man still dey betting shop and him never still go house till now.

We hear sey him wife with all the akawo contribution women dey for house dey wait for am, including community vigilante.

Even one caretaker for my area collect money from tenants for NEPA bill go do d same tin. Countryman, you know sey dis man, wey be Mr.Uka, get mind use compound NEPA bill take play 2 odd.

As I dey talk to you now, caretaker slip don cut, and NEPA don come cut compound light. Dem don pursue caretaker children for school fees and landlord don dey call caretaker to remind am of him rent wey don expire six months ago.

Chei countryman, dis matter strong-o!

 

Related posts

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments