Subscribe Now

* You will receive the latest news and updates on your favorite celebrities!

Trending News
Transport Wahala
Mainroad Life by Benjamin Paul Nsirem

Transport Wahala 

D different types of transportation wahala wey dey happen for our Port Harcourt, Rivers State, and Nigeria don plenty well well.

In fact, if we sey make we begin to talk how dis wahala don affect d different economic situations for our different States and Nigeria, e go plenty well well.

Before 25th December, last year, during d Christmas period, I dey rush to go somewhere, I enta bus from Lagos Bus Stop to Station Bus Stop.

Conductor say, “hold your N100 change oh! If you no go enta, come down oh!!”

I just stand small look d person wey dey talk sey person go pay N100 from Lagos Bus Stop to Station Bus Stop. Him no even send me.

I come reason sey, maybe him no hear me wen I say na Station I dey go.

Na im I come ask am, “from Lagos Bus Stop to Station Bus Stop?”

Countryman, d answer d conductor give me just make me tink plenty plenty tins.

Before d question.complete for my mouth, him just be have like say person wey him dey talk to na ant.

“If you no go enter, come down. I know come Port Harcourt to train …”

Him no gree complete d last part wey I just open my ear wide to hear.

Chei, countryman, no be small tin-o. D mata tire me. Na so e dey easy to spend N100, we be say from wia I stand, I dey see wia I wan stop.

Countryman, dis wahala strong. E don affect everytin wey dey for inside d country.

Na so I say mek Meruwaa,  Hausa Malam wey dey push water for truck, bring water come for me. D Malam say one rubber of twenty litres na #200

Na so I open mouth dey look Malam.

E be like say him know wetin dey my mind. Before I go recover from d shock wey him give me, Malam come dey explain:

“Kai! Transportation I don go of pinis”.

I come ask am, which transportation. Na im him tell me say mek I go find out how much one litre of fuel dey cost for filling station.

Laf wan kill me!

Meruwaa, wey dey push truck sef don say him truck dey use fuel.

D tin wey dey happen be say d transportation wahala don dey worry plenty pipul and plenty family well well, sotey many family wey travel for d festive period don turn to traders for road by force.

D transportation price don high too much, d place wey dem dey collect N500 before, now na N3,000, some place wey be N1,000, now na N5000.

Na so d transport money dey increase dey go every day by day.

Chei, countryman, no be small tin oh! Na so some pipul begin to sell d food items wey dem carry from dia different different villages, so dat dem go fit get money take pay dia transportation back to dia different places of work and businesses.

Some bus drivers and taxi drivers dey  carry dia passengers dey go stand for fuel line.

Countryman, dis wahala big well well, no be small. My broda, just look, look around you. See as pipul dey treck everywhere?

Na d reining tin now. Everybody dey treck, both big and small, sotey e don be like say we dey for trecking festival.

Dis transportation wahala don dey for every traveling agencies wey dey for dis country-o, no be only inside Port Harcourt.

Transportation money now from Port Harcourt to Abuja  na N35,000. Dis na money wey before some family fit take survive for complete one month.

Eveytin na because of say fuel price don dey go up everyday. As we dey sleep today, we no know wetin e go cost to buy one litre tomorrow.

Countryman, if like say e dey possible for those of us wey don dey treck to also increase tracking money, equation for balance small-o.

No be so?

 

Related posts

0 0 votes
Article Rating
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments